Top Songs By Oga Network
Similar Songs
Credits
COMPOSITION & LYRICS
Evans Ifeanyibema
Songwriter
Lyrics
Rain weh fall for harmattan
Cassava suppose value am o
But monkey nor wan know who plant banana
Na banana consign am ooo
Sheh them say if e reach mouth e go reach belle
Wetin come go Dey vex belle when e reach mouth
Help me ask belle
I wan know Wetin vex belle
Ahhhh ohoho haaaa
Rain Dey beat us
Sun Dey beat us
Hand Dey meet us
Government hold the thing weh go help us
Them nor Dey give us
Human Being and open eye
Hawk and fowl Dey one market o
Dey buy things dey put for one basket o
Dey hug each other
Dey share blouse and skirt
For here I nor know who be who
She tell her mama say she Dey go fight for her right
Cus since them born her government never treat her right
she nor know say she go d*e that night
Because the order weh them give na sh**t on sight
Honorable minister who dey off my mic
Na all these kind talk una nor Dey like
Una love loyalist weh go lick una yansh
But deep down una know say all una regime na trash
Rain Dey fall instead of umbrella you give me broom
Even the umbrella weh you give me na gone too soon
Money dey miss set up panel oko don dey fa*nt
From the look of things devil go first una repent
How you go say the IG live weh I watch nor real
But snake swallow millions make I believe abii
But put am for your mind say this generation different
We just Dey wait for the right time make Una prepare
We Dey come
Writer(s): Evans Ifeanyibema
Lyrics powered by www.musixmatch.com