Listen to E Never Tire You by Presley

E Never Tire You

Presley

Underground Rap

2,524 Shazams

Credits

PERFORMING ARTISTS
Presley
Presley
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Presley
Presley
Songwriter

Lyrics

My broda e neva tire u Na for only violence dem go dey hire u No be wen e reach for fight dem remember u You think say if na beta government work dem go hire u (na scam). Ahn, officer e neva tire u Abi your conscience e no dey bother u Just imagine say na me be d police, As u try resist my intimidation I jux murder u. Ahh, common man e neva tire u E go beta only wen d suffer tire u You wey dey support evil because e favour u Na you be d problem and I pray make God deliver u. Ahh, civil servant e neva tire u Dat your minimum wage wey no fit inspire u Dem dey loot, dem dey steal, dem dey lie, If u see dia lavish lifestyle I swear life go tire u. Listen up, my people listen up E don tay wey dem dey run am like say na dia papa shop (for wat nah) Turn it up, tell dem enough is enough Who no know make dem know Naija na for all of us I dey d background d country hard But as I look my people way e far Ah, If dem observe I swear dem go realize Say hunger no know religion and hunger no know tribe (lai lai) A good man whether na Muslim is a good man A good man whether na Christian is a good man But a bad man, you see that bad man, Forget im tribe or religion he's a bad man Okay, country people save ur face The world dey look say na only craze we sabi showcase Anybody looting public fund na enemy of state I see greatness in you my people let it surface. Ah, put ur hands up if u know say e don tire u Raise it up make dem know say e don tire u If u no talk and me sef I no talk And if nobody talk how dem wan know say e don tire u. Ah oya carry waka chook mouth for d mata The labour of our heroes past no go follow water Oya no dull d mata, abeg no dull d waka Nigeria shall be great again and dat na real matters. Ahn, be the change that you wanna see Give your best till there's nothing left for you to give Hold on we go pull through if you believe But first of all everybody put away your greed. Put away the hate, save yourself the pain Put away the bitterness and let there be love again All the killings and the tears e neva tire u If e neva tire u, my people e don tire me.
Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out